ADVANCED WARRI PROVERBS (1 to 77)

1. Woman wey never see problem... Na im
dey still hold breast run.
2. Woman wey dey find pikin no dey wearpant sleep.
3. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go hear am.
4. Na for afternoon dem dey find black goat.
5. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
6. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
7. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
8. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
9. Person wey don faint before no be stranger to death.
10. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.
11. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.
12. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
13. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail hims
14.IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
15. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
16. Na cricket tell him children say, Nomatter how ground strong, Them no go sleep outside.
17. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.
18.No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
19. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
20. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
21. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
22. Dem no dey tell tortoise say race don start.
23. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
24. Before you see monkey, monkey don see you.
25. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.
26. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.
27. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
28. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
29. Meat wey you dey forbid, no use yourteeth cut am.
30. My thing and our thing no be the sameoh.
31. Na happiness dey make prick stand.
32. Na as goat stand for market dem deyprice am.
33. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
34. Its a small world!! No mean say you fittrek from Naija go London.
35. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.
36.Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
37. Today’s newspaper na tomorrow Suyawrap.
38. Akara and moin moin get the sameparent, na wetin dem pass through makedem different.
39. Na person wey never see problem dey use English dey pray.😁
40. Book wey no gree enter head go enta exam hall 😂😀😀
41. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.
42.who naked no dey chuck hand for pocket...!
43. wetin concern dog wit family planning?..
44. Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
45. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.
46. Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson.
47. Na over confidence make February no complete.
48. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
49. Head wey no wan think go carry load..
50. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.
51. Forget Trust 😁😀😂 If trust dey, Water nor for boil Fish.
52. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile 🐊. ✌
53. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.
54. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote 🙄🙄
55. Escort me, escort me naso slave trade take start.
56. It's a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
57. Christianity is free, but you must buy Bible
58. Person nor dey use shame chop winch o
59. Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.
60. You no need spoon and cutlery to chop slap.
61. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
62. The patient dog 🐶... Nah hungry go kill am.
63. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.
64. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants.
65. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey.
66. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh
67. Pastor wey dey pray for mad person no dey Close eye.
68. I know too much, i know too much na e make SAN no fit recite National Anthem.
69. This write up good, this write up good, na e make me (the writer) no come know how to count 1,2,3 again.
70.The tin wey make egg strong for port nai make yem also soft for port
71. Pikin way Say e mama no sleep, he self no go sleep.
72. Monkey smart monkey smart, nah because tree near tree
73. Na cooperation dey make rice full pot
74. Cockroach wey say him sabi acrobatic dance where cocks are doing general meeting don waka kurukere waka
75. Say Lion dey sick, no mean say him wit cat na mate.
76. This burial rich, this burial rich, na e make to die, hungry elders
77. This writeup sweet you, no mean say you no go like my page and share this post.
Comments